Now the people no fit wait
Make we better this place
E don tey wey the government don dey fuck up
2023 leaders con dey talk say make we no dey wait am
Make we fight now, see the people wey dem kill
How you wan take solve am
Intelligence no mean say you no go fit fall for your mouth trap
Out of a body experience, makachukwu make you no dey blow crap
Bad when the leaders wey suppose dey show you road no kukuma know how
Ogini ne me, wanene, who be that, wey go lead well
Tolerate dem go misbehave, talk am for speaker make we dey hear
Solution no dey for junction
Sotey camera sef no dey function
Wey you wey the evidence dey
Wey you find for corner of toll gate
All of them na the same cartridge
Sega Mega Drive system na same game
All of them na the same bird cage
Political parrot we no do again
When you talk am out, you must do am then
If you e no deliver, e no get belle
Suppose knack am again with the ogede
Make she know say you get the ogene
Then you fit dey sit down dey feel brekete
Make we better this place