Na jeje jeje we sit down for our land o
Na jeje na jeje we dey mind our business o
Some people come from far away land to take our land o
Dem fight us dem kill us Dem cheat us to take our land o
Se na the civilization wey them say them want be this o
Civilization me I know na advance stage of development
Se the civilization wey we see for here na him be
We no dey develop anything
The big big people Dem dey do there own
Them dey dabaru the people for here
Them go come dey blow them lies for TV
Them go dey make noise for radio
say them get plans for us
No food no road no light no house everything just dey gboin
Everything just dey gboin
Everything just dey gboin
everything just dey gboin
everything just dey my tight 2x
This oyinbo people them be unnecessary visitor make them dey pack o make Dem leave out countries
Make them pack o make the leave out continent
everything just dey gboin