All the matter don taya me sef
Nothing wey Dey inspire me sef
Even me myself I don taya for my matter
Which advice dem wan borrow me sef
Cos e be like say dem don follow me sef
For my mama house o abi na my papa
Me I need one thing wey go motivate me
Sit me down make you educate me
Say these things e normal
Make nobody Dey underrate me
Cos I sure one day dem go celebrate me
Say these things e normal
Make person tell me say e go better
Make person tell me say e go pure
Cos as I Dey so my faith e no strong again
Make person give me assurance for my matter
Make person tell me say he go set
Cos as I Dey so my believe no strong again
Say my believe no strong again
Me I need somebody wey go elevate me
Make nobody come Dey underrate me
Make somebody help me keep my head up o
Need somebody wey go energize me
Make nobody come Dey criticize me
Make somebody help me keep my head up o
Say me I need one thing wey go motivate me
Sit me down make you educate me
Say these things e normal
I say make nobody Dey underrate me
Cos I sure one day dem go celebrate me
Say these things e normal
Make person tell me say e go better
Make person tell me say e go pure
Cos as I Dey so my faith e no strong again
Make person give me assurance for my matter
Make person tell me say he go set
Cos as I Dey so my believe no strong again
Say my believe no strong again
My believe no strong again