If I get this money I go sempe
If I get this money I go flenjo
Say I dey hustle make I denge
Say me wan show boys love for December
Nobody afi know the pressure man face
But I dey zip up I just dey for my space
I no fit get am today but na just phase
Iwofe PH City na there I base ( Omo ask dem, dem know my matter!
More money more problems but i want more
More money more compass so I want more
More money more shenkess so I want more
More money more money so I want more
More money more problems but i want more
More money more compass so I want more
More money more shenkess so I want more
More money more money so I want more
Since I start to chase this money me I never look back
Money wey go make POS hang if I put card
Make dem halla who's that? Na me Wave zaddy!
For the street of course I pin ( no put body )
When I no get shimgbain Shey dem been Shenk us ( life )
Shey dem no send us now girls wan befriend us ( life )
Now we dun get money wahala dun wear fine cloth!
When you from Benz enter Corolla
You go know why I dey swear for Lexus
Ball till eternity vanity dem go beg us
I dun delete my WhatsApp cause dem use OPay dey stress us!
Ah baba comot body you dey when life been stress us!
Now dem wan dey feel among but we no go put dem on
Cause dem been no dey when we dey suffer gan wave zaddy!
More money more problems but i want more
More money more compass so I want more
More money more shenkess so I want more
More money more money so I want more
More money more problems but i want more
More money more compass so I want more
More money more shenkess so I want more
More money more money so I want more