Igirigiriga ginegirigiriga oh
Amaka na senior girl for house
She get many siblings for house
Mama papa paralyze ooh chey
To make Family to dey alright
She just realize oo oh oh
Say Amaka no Dey sleep house o
Dem won make Amaka craze oh
Amaka Amaka won to gbalaga
Family problem don dey choke oh
Amaka oh Amaka won to gbalaga
Family problem don Dey too much
She won to gbalaga oh no no
Everywhere everywhere go soft
Emeka na senior boy for house
35 years he still dey for house
He mama say Shey no be your mate o
Dey build house for their parents
If na yahoo make you do do do
Say Emeka no Dey sleep house o
Dem won make Emeka craze oh
Emeka Emeka won to gbalaga
Family problem don dey choke oh
Emeka oh Emeka won to gbalaga
Family problem don Dey too much
Everywhere everywhere go soft