Life too short to put trouble first
Life too short to put trouble first
Wahala be like bicycle, I don't want to ride it
E be like person trouble, I don't want to find it
Wahala no good for body, I don make my findings
So where dey stressfree, na there wey you go find me
You no go fit find me for where wahala dey
And I can't give to you what I can't take
Me and my guys, we no suppose to fight o
So where kasala dey, I no dey the group chat o
Nothing wey dey worry this guy
Some people dey wear trouble for body like suit and tie
But you see I no get their time, oyeh
For my life I no dey worry any man o
To dey on my own na the plan o
So when yawa e go come and kasala go burst
Dem no go say I dey their band o
For my life I no trouble any man, I no trouble any man o
To dey on my own na the plan o, oyeh, uhhhn