Life no be by power omo na jaguar wife
I look serious but if we close
I go pí before dem hype my hype
I no go need ur permission
When it's time for me to shine my shine
Before I take a break I need a break through
World people if u let them dem go break you
I thought I told the mxdxfxckxs they can stay tuned
More grease to my elbow or gimme break fluid
I get e back up for my back up plan
I get e back up for that back up of my back up plan
I get e reason I dey back up all my back up plan
If e no dey pay back up plan
U go look well before u burst code
Just like u supposed to dey look before u cross road
Just like u supposed to dey push before u come blow
cnd continue to dey push after u don blow
Dem talk say na ur time be the best
Oluwa time never still reach for me to flex
Tell me today wether na months or years remain
Coz I dey feel like na only me remain make u bless
U don bless adeleke bless balogun ayo
Damini blessing u finish work him no fit die poor
House wey u give temitope him buy like 2more
When u go come my house with things wen I dey pray for
My friends wan carry me go where dem dey do jas
If I do jas u know say man u no go too last
I no wan money wen I go come finish too fast
Or take my life by 35 if I too last (No!)
Only u fit make maggot turn python
Help us fight people wen wan come fight us
Many people get winsh dem no know
Tell dem ur plan e go spoil how e spoil u no know
One billion dollar in my head
But billing billing e nor dey end
Characteristics of human being
Complicated and I nor fit see
This race too long man gats to run am
Poor man nor dey get competition
Where I'm from we nor dey give up