Nah our land, nah our people
I hear gunshots louder than church bell
Sunday morning but the streets still hell
Smoke for the sky where the sun suppose shine
Another mother kneel down asking Why mine?
Pikin dey shake anytime door knock
Night time silence broken by shock
Daddy no return from journey again
One phone call everybody dey cry
Farmer wey plant food no fit reach farm
Fear don turn every prayer to alarm
We dey breathe but e no feel like living
Too many tears but nobody receiving
North side crying, south side too
Pain no dey ask who be me or you
Same red blood when the body fall
When one part bleed, e affect us all
Same blood, different fear
We suppose love one another
Too much blood for the sand
We dey pray hands up high
Make the killing stop tonight
Let there be light eeeeee
This no be tribe matter, this na life
Bullet no dey ask if you wrong or right
Blood no get language, tears no get zone
When mother lose child, she mourn alone
Mosque and church for the same street
But fear don make the love incomplete
Politician talk say “change go come”
But graveyard full and we still dey run
Young boys angry, dem carry pain
Some turn am weapon, some go insane
If Killing be the seed wetin we go reap?
If peace be prayer why we no dey keep?
We all dey bleed red make we reason
Before this pain turn permanent season
Too much blood for the sand
We dey pray hands up high
Make the killing stop tonight
Let there be light eeeeee