LyricFind Logo
LyricFind Logo
Profile image icon
Lyric cover art

Hello Shola

Apple Music logo
Deezer logo
Spotify logo
Lyrics
Hello Shola
Yesterday I ask of you
Your mama tell me say
You don dey do yahoo yahoo
Hello Shola
Yesterday I ask of you
Your mama tell me say
You don dey do yahoo yahoo
So wetin you wan make I do
No be you dey tell me make I go to school
Say when I komot I go see better work
Now I'm finding out that rubbish no be true
Cos I waka under sun tire
Submit CV for everywhere wey dey wan hire
Go different interviews beg them to put me on trial
Waka from Iyana Ipaja to Lekki everyday
Only to get what? A salary of 30k
How I wan take use that one survive
Support my siblings, pay my rent and start my life
When all my mates don dey build house dey marry wife
But here I am still dey struggle for a 9-5
Or shey na my fault say my own family poor
Problem wey money fit solve, they tell you take it to God
I bin wan travel abroad but I dey struggle to chop
Uncle wey promise to turn up no longer dey pick my call
But you tell me make I no complain
Say everybody get the part where him shoe dey pain
Na why I dey my dey and respect myself
Shebi as you no help me then I go help myself
Hello Shola
Yesterday I ask of you
Your mama tell me say
You don dey do yahoo yahoo
Hello Shola
Yesterday I ask of you
Your mama tell me say
You don dey do yahoo yahoo
So how you expect make e be
You go dey for me
If I come your house and I beg money
You wey dey mock me every single time I dey in need
How dare you judge me for the path that I chose to be free
Cos where you dey when my mama dey hospital
And sorting her medical bills was impossible
No be ignore wey you ignore me when we come meet you
And now you got the nerve to judge me on some moral issue
Like what's wrong with you
Like say if dem show you way you no go join them
Like say na me be the country only problem
I know it makes you feel good when you pass your judgement
But if you need someone to blame, look at your fucking government
Wey carry our country money overseas
And leave me and you for here to hustle for their kids
Na why I dey my dey and respect myself
Shebi as dem no help me, i suppose help myself
Oooh Hello Shola
Yesterday I ask of you
Your mama tell me say
You don dey do ya ah ah ah ah ah ah
Hello Shola
Yesterday I ask of you
Your mama tell me say
You don dey ah
You don dey eyyy ahhh aahhh
Oni suru l'oma tele yi pe
Ahhh ahhhhh
Oh Shola Shola Shola Shola
Hmm Shola Ah Shola
Ooooh Shola Aaah Shola

WRITERS

Idris Olawale Bakare, Mayowa Ibidapo Amund

PUBLISHERS

Lyrics © AFRO SOUNDTRACK

Share icon and text

Share


See A Problem With Something?

Lyrics

Other

LyricIQ Analysis

Top Emotion

Sadness

Sentiment
Thumbsup IconThumbsup Icon
Theme

Sexual