Person wey dey cry still dey see road o
Him tell me call my number him no dey pick call o
Na so dem puff my paddy for bus stop o
Nothing we no dey see inside ghetto
But we no reach the standard
As we dey suffer the suffer
Them mo some panya for uptown o
Ghetto boys for dey smile
Many talent in the ghetto
If you know how the thing go
You go pity for the ghetto
Too much suffer in the ghetto
Different squad in the ghetto
You go pity for the ghetto Boys
Emeka been sabi play football o
Sharp striker wey no dey dull o
Emeka dream na to play for Italo
And everybody been dey feel the boy o
Na hunger change him big dream
Beta striker don dey do things
Emeka turned to a big thief
Him don dey serve for Kirikiri
Many talent in the ghetto
If you know how the thing go
You go pity for the ghetto
Too much suffer in the ghetto
Different squad in the ghetto
You go pity for the ghetto Boys
If to say beta hospital dey
Fatima for no die that day
Had it been beta road e dey
Container for no kill Ade
Everybody wey die come be sara
But i know say no be normal thing o
Make una continue to dey rest