LyricFind Logo
LyricFind Logo
Profile image icon
Lyric cover art

Port-harcourt

Apple Music logo
Deezer logo
Spotify logo
Lyrics
Life no easy for port harcourt
food for the table my mama does
Even as a nwatakiri she go Dey waka from borokiri to transamadi
Just to feed us,
my papa sef he leave us,
them no want so they cut off oo
cut off Like scissors oo

Me I go fit die for my mama cause
me I no wan cry say my mama loss
Me I go fit kill for my mummy
Mummy wipe your tears i am Sorry

The person you are looking is a bad boy
But when em mama talk na attention
Anything you talk na your concern
All my decisions na for mummy

She been Dey hawk from trans amadi
then move down to borokiri
She no go let me anyanmiri
Oh why I love you oh my mommy

She been Dey hawk from trans amadi
then move down to borokiri
She no go let me anyanmiri
Oh why I love you oh my mommy


Time,flies.
We no book e bolt,okada we been ride
Chai.. why?..
Money mummy get na to cook e Sunday rice
Mummy was my doctor..doctor x3
She was my pastor..pastor x3
For rumokoro wey we live..
We Dey hangout for the street
Rumumasi on wheel
We Dey hustle just to feed
Me I no wan break e my mama heart
So I come Dey grind and I Dey work hard
Anytime I submit e my report card
Naso I Dey make e my mama proud
(Kpos)

Them been dey call me nama shobiri

my maleh no gree

Those wey no believe pasisi make them gbo digi

From Mgbuoshimini soibi say na so e be

Some say i dey camel with k leg and no decree

Father lord
Guide my steppings
na me my mama dey count on like abacus

No fit forget the times wey I been move my mama rubs

Na why i dey on on my grind to make sure my mama soft

Omo this game of life you seff know say na marathon

Oluwa gave me Benz when I been dey find Avalon

Na why i dey hustle like na only me my mama born

she rather starve instead of to let hunger to mama us



She been Dey hawk from trans amadi
then move down to borokiri
She no go let me anyanmiri
Oh why I love you oh my mommy

She been Dey hawk from trans amadi
then move down to borokiri
She no go let me anyanmiri
Oh why I love you oh my mommy"

WRITERS

Christopher Victory

PUBLISHERS

Lyrics © AFRO SOUNDTRACK, Kobalt Music Publishing Ltd.

Share icon and text

Share


See A Problem With Something?

Lyrics

Other

LyricIQ Analysis

Top Emotion

Sadness

Sentiment
Thumbsup IconThumbsup Icon
Theme

Sexual