Officer stop my car say him dey persive gbana…
Officer nothing dey this car except my wheel spanner…
E say shut up my friend why you fresh like that sheay you from Ghana…
Officer no reason am as you see me I no be scammer…
This boy is like you no dey fear the law sheay you be nammer…
Officer the only law I dey fear na that of karma…
Mr oga I am not here to play let me see your paper, Officer raise Batton for up
Say him go nack me that harmer...
Officer why your uniform dirty like that shey you dey work with lawma
For your division shey you wan tell me say you be farmer...
E say when you were coming from this side shey you no see our banner
Now see my superior there oga you don jam her
Now see my superior there oga you don jam her
She no dey hear sorry na 50k you go use calm her
Officer abeg shift that side shey you dey smoke Palmer
Why your berret cover your face and e be like head warmer... ahh
Officer officer agbawo heeeee
Officer officer agbawo heeeee
Officer officer agbawo heeeee
Officer officer agbawo hee
We Nigerian have never experienced freedom
Listen properly I am not here speaking in idiom
I even prefer those day that we where been colonized
If you think say I dey lie go ask Tuface, edris and nice
Them say we get freedom when I no fit carry dread
Sars go beat you and still demand money for bread
Because every time I wake up and see I am still in Nigeria
I just feel like trekking from here down to Algeria
Every time I dey wake I dey vex for my resident
Because I don't see why I should be rules by a photo copy president
The one wey dey pain me pass na our police
Constable go stay dey beef with 2ic
Where arm robber dey we no dey see them
Make them hear Yahoo boys there go wan bill them
Offense number 1 your are using the latest iPhone
Offense number 2 your hair is rough and you didn't comb
Officer stop my car say him dey persive gbana…
Officer nothing dey this car except wheel spanner…
Shut up my friend why you fresh like that sheay you from Ghana…
Officer no reason am as you see me I am not a scammer…
Officer stop my car say him dey persive gbana…
Officer nothing dey this car except my wheel spanner…
Shut up my friend why you fresh like that sheay you from Ghana…
Officer no reason me as you see me I no be scammer….
Officer officer agbawo heeeee
Officer officer agbawo heeeee
Officer officer agbawo heeeee
Officer officer agbawo heeeee
No be everybody wey dey wear Gucci dey do Yahoo oo.no go whyne me ooo
Okay wait because I no get money na
It make you dey use my atm card dey do ruler abi
Issoryt, everywhere smooth ooo dice dey change face ooo
Officer no dey do like that your pikin sef still dey hustle ooo
Officer take am easy with boys na