Make I clear you the matter
Touch that man for the corner
If e set now I'm gon ride for my brothers ( I go pull up )
Roll one tie for my brother
Make i clear you the matter
Came into the game i terrorize them
Check my disco i get yur anthem
I know the real I know the fake
But i de smile with everyone
We go still laugh we go still shake
You gat de scared of people
Make dem no take you unaware
Who no get helper suppose wise
At your lowest nobody gat you like you gat you
If yur raba stop to pass them many wey go lusgard you
Na who turn up be your guy
No be who talk say he go lap
Leave the Matter for Martha she go solve am with Mathais
Small boy with heavy dreams
Joseph de learn for where I de
I know say dem go call me legend when my body don decay
Give me rose when I'm alive
I need the money now I'm young
Tears nights wey I no sleep
Cuz I wan pull up in a whip
Where I'm from na only hope na we de feed on
You no fit see me finish cuz you no fit see me
Salvation is free but holy water na 10k ( pastor why )
Them no fit deny my pen game
Eyes closed but i de see the vision clear
Story mode and i sabi the mission well
No chow for who no de work
Konji and sapa nah guys who no get money no de fuck
Learnt from the hard days thankful that they came
Cuz I for no realize say everybody no be same
Until you don de get the pay
All of them go wan relate
No waste time too delete them
Brah delete them comot yur system
Make I clear you the matter
Touch that man for the corner
If e set now I'm gon ride for my brothers
Roll one tie for my brother
Make I clear you the matter